Friday 27 December 2013

CHRISTMAS...TO CELEBRATE OR NOT? (IN PIDGIN)

Good day my people!
E get people wey I wan dash human rights now...
If you know say you sabi when you born, that is, you no depend on wetin Nurses, doctors or your maleh or paleh tell you...let me see your hand.
If you don raise hand, I don dash you the right to take argue the actual day when Jesus born.
If you never raise your hand, you don dey argue....you no get right to argue the day when Jesus Christ born enter this world.
The Day when im born or why we no suppose celebrate am, how e take bother you? The important thing no be to remember and appreciate how im take die come save you? And to remember how im die, you gats remember why im take born....na why Christmas come dey.

Yes, na that day them been dey celebrate sun god. If you born come hear say na the day wey you born them been born one kind masquerade join, you go change birthday abi? Or you go just talk, "anh! wetin concern me? I dey celebrate my own birthday".
Even though some people don de over-rate this Christmas, dey concentrate on how to chop chicken, wear cloth, forget the main essence of Christmas....you wey remember, no be say you no fit celebrate Jesus everyday of your life oh, which na the gong gong thing, but you no see say e  follow good for all CHRISTIANS in unity to choose one day to celebrate and thank Baba God? E no fine so?
Baba God give us im only pikin for Christmas make im come die, so that you and I no go suffer....no be good thing?
You no dey hear "Love came down at Christmas"?
Abeg, my brothers and sisters, no carry your own belief and judgment come confuse another person. You have your own, I have my own....if you wan tell me wetin you dey believe, you fit tell me, I go choose whether to listen or not, no force me, no be fight.
Whether Christmas na 25th or no be 25th...whether Bible talk say make we celebrate the day wey Jesus born or not....Jesus born, come live, die for me, now I be free person...I go celebrate am, thank am join, Baba you too mush, you don do me well.

As for the argue argue people, House of Assembly, House of Reps, dey find people to bring ideas, to argue make our country better….no come facebook to show your 'debater' skills...even when you know say you no suppose argue.

Finally, if you wan celebrate Jesus’ Birth personally, do am….if you wan celebrate am with everybody, you dey free…if you no wan celebrate at all, you kukuma dey free. We no dey quarrel. Na so one guy talk say "Whether or not you celebrate Christmas, it isn't a guarantee to enter Heaven's gate, so why bother?"

#ikor #word